[SN Pidgin] Super Eagles Don Move Up For D Latest Fifa Rankings


Naija Super Eagles don move up three places for d latest ranking of football playing nations by FIFA and now dey don occupy d 41st position but dem still be d fifth best team for d continent.
Na Carthage Eagles of Tunisia be Africa best team followed by Egypt, Senegal and Congo DR for d top five.
D Indomitable Lions of Cameroon, Morocco, Ghana, Burkina Faso, and Cote D’Ivoire na dem make up d top ten for d continent.
Germany still remain d world best football playing nation, and na Brazil follow dem for back, with Portugal, Argentina, Belgium, Poland wey don hold unto dia position for d top six.
France dey d seventh position den Spain, Chile, and Peru make up d top ten.

Comments

Popular posts from this blog