[SN Pidgin] Buhari Be Ethnic Champion, Religious Bigot, And No-1 Disunity Promoter – Fayose



Governor Ayodele Fayose wey be governor for Ekiti State, don react to wetin Buhari tell world president, Jim Yong Kim, as Buhari tell world Bank president make dem focus wetin dem dey do to North.
– Him talk say shebi him warn Nigerians wen dem wan vote and make dem no doubt my talk, say Buhari no dey see himself like president, but like ethnic promoter and division remoter.
Governor Ayodele Fayose for Ekiti state don talk say, Nigeria dey divided now dan as e dey before as di unity wey dey Nigeria now dey under threat.
Him talk dis, as him dey react to statement wey World Bank president, Jim Yong Kim talk, say Buhari tell am make dem no do anything for any State if not Northern region.
Di statement talk say :
“Based on nepotism , religious bigotry and favouritism wey him dey do , Nigeria don dey divided more dan how e dey before, and di Country unity dey under threat “
“Wen person wey be president fit open him mouth and talk say, people wey give am 97% votes nogo get allocation like people wey give am 5% votes. People wey love dis Country as dem dey claim, suppose shout, di time him talk am, and based on wetin wey go hapun as dem get nepotistic president. Shebi i warn dem, but dem no listen to me “
“Another thing again be say, as Buhari be ethnic champion, religious bigot and number one promoter for disunity in Nigeria don show through wetin World Bank president talk .
Fayose tell Nigerians say, him shout for three months wen Buhari enter office as president, say Buhari dey work as president for North people alone in Nigeria, and nobody listen to am.
Him say,
“Dat time , I talk say, di steps wey Buhari dey take since May 29,2015,dey show ethnic and tribal colour wey no dey good and dey destroy unity for Nigeria..
“I also tell Nigerians about nothernisation wey Buhari wan do for Nigeria, as him no dey use Federal character again.
“Dem tell us say, Buhari give appointment based on merit, i asked dem say, whether him no see any person wey dey good for di appointments for SouthSouth and SouthEast for dia APC. ,
“As e dey Now, World Bank president, Jim Yong Kim, don tell di whole world say Buhari wey be Nigerian president no be for every person wey dey Nigeria , but for North , as e show well well for di instructions wey Buhari give am. Buhari tell am say, make dem shift dia development to North,and e don make am dey plain say, Buhari no be president for every person wey dey Nigeria.
Di question be say, we go still dey close mouth for di evil wey dey hapun for our region, or e nogo dey better if we rise and challenge di Nepotism and bigotry wey North people dey do?

Comments

Popular posts from this blog