[SN Pidgin] Go Find Good Left-Back! Udeze Don Warn Gernot Rohr



Former Super Eagles and PAOK Salonica left-back, Ifeanyi Udeze, don call Gernot Rhor attention say make him find good left-back alternative and reinforcement for Elderson Echiéjilé unto d 2018 World Cup for Russia.
Dey don dey see Echiejile as Super Eagles weakness for d defence department and plenty of Naija fans don dey criticize d Sivasspor left-back recent below-par performances for most of d World Cup qualifying games.
Udeze tell completesportsnigeria.com say;
“I no go single out any left-back wey dem fit add for d team unto say we no get plenty of dem around,”
“But I feel say d coaches suppose monitor d Naija Professional Football League so dem for fit invite d best performing left-back so him for play friendlies ahead of d World Cup.
“Even as dem dey talk all dis one about Echiejile, d experience na d main thing. Him dey important to dis team, but another quality left-back dey necessary. For me, I go say make we give one home-based player chance.”
“D squad dey solid, but I no go mind if dem bring back Obafemi Martins and Emmanuel Emenike to d team, make dem for support Odion Ighalo wey true true be our best striker as at now.
“We need dese experienced guys for d World Cup. We suppose get blend of youth and experience for d team for World Cup”.

Comments

Popular posts from this blog