[SN Pidgin] South African Presido, Jacob Zuma, Go Land Imo Today For Visit


Imo State Governor, Rochas Okorocha yesterday don open up talk say South African Presido, Jacob Zuma, go from today pay two-day visit to dia state.
As him dey brief journalists for the Government House, Owerri, wey be d state capital, Okorocha yan say Zuma, go sign Memorandum of Understanding (MoU) between Rochas Okorocha Foundation and Zuma Foundation although him get plenty oda things wey him wan do.
Again, dem expect d visitor to assess d planned over 20,000 hectare, Egbema Industrial Park wey dey cost over N2 billion and d Sam Mbakwe International Cargo Airport.
Him say dis agreement to do make d two of dem fit dey work in partnership to move d interests of d humanitarian bodies together

Na wetin him talk be dis;
“D South African President, Jacob Zuma go pay two-day visit to Imo on Friday. We dey work on partnership for d Egbema Industrial Park, management of Imo International Cargo Airport and South African Airline.
“My interest na to see say d airport take off to help lift our exports, joint work on education and den sign MoU between d Rochas Okorocha Foundation and Zuma Foundation,”

Comments

Popular posts from this blog