Yawa gas as SARS net catch jaguda people wey dey terrorise Ikorodu (Photo)

The Anti- Robbery people for state criminal Joinbody Yaba, Don catch four guys gang wey dey kolobi people properti for ikorodu, Lasgidi.

The suspects are -  Akin Ayotunde, Isaacs ogbona , sola dede and sodiq Lawal.

Dem be ogbonge for kolobi people properti, dem go first off people generators before dem carry dem bad act.

Water come pass Garri as yawa come gas last week Thursday, after them go do another kolobi for igbe area of ikorodu.

Na six hours them take do them kolobi, dem kolobi generator, car, money, phones, ATM, modems, jewelry, laptops and dem use the ATM take withdraw N100,000.

Comments